Charles Soludo: Gunmen attack former CBN boss Chukwuma Charles Soludo, kill three aides

Soludo

Wia dis foto come from, Getty Images

Gunmen don attack Prof. Charles Soludo, former governor of di Central Bank of Nigeria (CBN) wey indicate interest for di November governorship election for Anambra State.

Dem shoot dead Three policemen wey dey among di security aides attached to Soludo for di attack.

DSP Ikenga Tochukwu, Police Public Relations Officer for Anambra State, confam di attack.

'Attack on Charles Soludo fit dey politically motivated'

Di attack on one Soludo wey be one of di aspirants for di Governorship election for Anambra State, South Eastern Nigeria fit dey politically motivated, na so one support group don allege.

Di Independent National Electoral Commission (INEC) dey hold di Anambra Governorship election eight months from now, November 6, 2021.

"Wetin happun to Professor Soludo dey politically motivated. And di plan na to discourage am and all im supporters ahead of di election," na wetin Chinedu Nwoye Glamour, Chairman of All Soludo Support Groups tell BBC Pidgin.

Glamour say, "di attack happen between 4pm and 5pm after Prof. Soludo don finish im consultation for Isuofia community for Aguata Local Government Area of Anambra State. Di officers wey die dey try to protect Prof. Dem even kidnap one of im aides.

"Police dey on top of di matter and we hope say dem go fit find di people wey carry out di operation."

No group don claim responsibility for di attack but dis incident dey happen just as jaguda boys dey attack and kill security agencies especially Police officers for South Eastern Nigeria.

Recently di Police High Command bin parade 16 suspects wey dem arrest for different parts of di region wey allegedly dey involved for di killing of officers and attack on Police Stations for South East.

Who be Chukwuma Soludo?

Professor Charles Chukwuma Soludo na di former Governor of di Central Bank of Nigeria.

E bin graduate with degree of Economics from di University of Nigeria Nsukka.

E don work for di World Bank from 1993 for both long and short term work as consultant.

Professor Soludo bin start for di Obasanjo administration as di Economic Advisor to di President and di Chief Executive of di National Planning Committee.

For 2019, Nigerian President Muhammadu Buhari bin appoint Soludo as member of im Economic Advisory Council (EAC).

For 2009, wen im bin contest for Anambra state governorship election under di Peoples Democratic Party, e later lose to Peter Obi of All Progressives Grand Alliance.

Tori be say e bin announce say im go run for govnorship under di All Progressives Grand Alliance (APGA) for February 2021.