Seyi Shay Nigerian Idol: Seyi Shay feedback to Nigerian Idol 17yr old contestant vex many

"Seyi Shay Nigerian Idol"

Wia dis foto come from, InSTAGRAM

Wetin we call dis foto, Seyi Shay and Nigerian Idol contestant Torrus
Read am in 3 mins

Seyi Shay Nigerian Idol feedback to one 17 year old contestant don vex many young pipo across di west African kontri.

Di Nigerian Singer-songwriter tell di teenager say: 'You're Never Going to Make it as a Singer'.

But di young man don reply Seyi Shay say im no go ever stop afta her feedback wey provoke many sotey e climb top trends on Monday.

For inside video clips of di audition wey don go viral, Seyi Shay wey no dey impressed wit di boy performance as e appear before di judges tell am say e no go make am as a singer but e fit make money as a song writer.

''Somebody don lie give you. Somebody tell you say make you come here do audition. Go back go tell dem say dem no be your friend because dis your audition, you no try.

"Your voice sweet to tok and e show wen you dey sing but your performance na zero. You no go ever make as a singer. I love you, you dey so sweet but you no be singer. You no be singer.

For song writing, hit me up, we fit tok but singing no go work. Sorry Darling'' she tok."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

From di audition, di young boy voice bin dey shake and di comment by Seyi Shay show fear and disappointment for im face.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Seyi Shay response to di Nigerian Idol controversy

Nigerian singer Seyi Shay don thank everybody wey dey make her trend for Nigeria social media, she say dem dey make her feel like Judge Judy.

She bin tweet dis one afta pipo reaction to her comment about one 17 year old male contestant wey come audition for di popular Nigerian music show, di Nigerian Idol.

Seyi wey be one of di judges for di show don chop plenty criticism from Nigerians for social media.

Nigerian Idol contestant reply Seyi Shay feedback wey provoke many

Meanwhile, di young man wey describe himsef as @ayoturri for Instagram also tok say im no go ever stop,

Many Nigerians don chook mouth for di mata for social media, some say na her work she dey do, others say di way she follow di boy tok no good and e dey very discouraging.

"Seyi Shay Nigerian Idol"

Wia dis foto come from, TWEEP

Wetin we call dis foto, Reactions to Seyi Shay comment on Nigerian Idol
"Seyi Shay Nigerian Idol"

Wia dis foto come from, TWEEP

Wetin we call dis foto, Reactions to Seyi Shay comment on Nigerian Idol
Reactions to Seyi Shay comment on Nigerian Idol

Wia dis foto come from, TWEEP

"Seyi Shay Nigerian Idol"

Wia dis foto come from, TWEEP

Wetin we call dis foto, Reactions to Seyi Shay comment on Nigerian Idol

Who be Seyi Shay

Seyi Shay real name na Deborah Oluwaseyi Joshua Odedere. She bwe Nigerian based singer, song writer, recording artist and perdormer. Her song Seyi or Shay wey she release for 2015 blow her into limelight.

Dem born her for Dec 21 1985 for Tottenham, London England and she be di last born. Her mama na from Northern Nigeria and her papa na from di western part of di kontri.

Seyi attend Command High School, Maryland, Lagos for her secondary school education. she later go London for her undergraduate studies. Firstly, she attend one local UK college where she studied music, then move go di University of East London, where she get degree in Business Management.

Shay sign her first record deal with No Apology. For 2006, she form girl Band, Boadicea. Di bnd scata for 2008.

Hit songs like Right Now, Yolo Yolo, Gimme Love, Irawo, make her popular.

Nigerian Idol bin reveal her as one of di judges wey go dey for di 2021 show.