Nneka Agbanusi: 'I dey happy say my dance dey inspire pipo'
Known for her dance videos on top social media platform Instagram, 31-years old Nneka Agbanusi say she dey "happy say her dance videos dey inspire pipo".
Nneka begin notice say she don dey put on weight wen di drug wey dem give her to treat her asthmatic health condition begin show e side effect.
She siddon tok to BBC Pidgin about some of di reactions wey she don get since she begin do her dance videos and why she feel say pipo like her "no need shame about dia body."
Producer: Moseph Ekine.
Video journalist: Gift Ufuoma.




