Oxford AstraZeneca vaccine side effects: COVID-19 vaccine effect Lagos Health Commissioner reveal

AstraZeneAstraZeneca vaccine: COVID-19 University of Oxford "AstraZeneca vaccine side effects"

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Oxford AstraZeneca vaccine for COVID-19 na special prevention injection against coronavirus.

Authorities for Lagos Nigeria don confirm say di AstraZeneca covid19 vaccine fit cause some side effects for pipo wey collect di injection, but e go wear out with time.

Lagos Commissioner for Health Akin Abayomi wey be virologist and professor for im medical field say im no feel any bad effects di first day wen im take di vaccine but im get slight bodi pains and headache di next day.

E say "di next day I feel burn pains, a bit cold and di injection site dey a bit sour, I take panadol, do exercise and go sleep, wen I wake up, I dey alright".

Tori bin comot for local media say pipo wey take di AstraZeneca covid19 vaccine for Lagos dey feel serious side effects.

Kontris like France, Austria, Irish Republic, Denmark, Norway, Bulgaria and Iceland don suspend di Oxford-AstraZeneca vaccine with immediate effect sake of [blot cloth] complain of health concerns reports.

But di Health Commissioner say di side effects go differ from pesin to pesin and some pipo no go feel anything at all.

Prof. Akin Abayomi say some pipo wey take di vaccine go feel di following side effects.

  • Headache
  • Fever
  • Body pain
  • Shivering
  • Pain for injection spot
"Oxford AstraZeneca vaccine side effects"

Wia dis foto come from, Prof. Akin Abayomi

Wetin we call dis foto, Prof. Akin Abayomi wey bin test positive to COVID-19 months ago, collect di Oxford AstraZeneca vaccine on 12 March, 2021.

One in five million pipo wey take di vaccine fit collapse or enta shock.

But dis no be only for covid19 vaccine, e fit happun to pesin wey collect any oda vaccine.

World Health Organization say side effects of COVID-19 vaccines include fever, muscle pain, redness for injection spot, fatigue, headache, diarrhoea etc.

Dem say di side effects dey comot on dia own within days.

Di commissioner say goment no permit any private organisation to administer COVID-19 vaccine, say na only goment fit give di vaccine for now.

"Oxford AstraZeneca vaccine side effects"

Wia dis foto come from, Nigerian Government

Wetin we call dis foto, University of Oxford AstraZeneca Covid-19 vaccine side effect matter don make Nigeria health authority clear di mata.

Di Nigeria goment say di Oxford-AstraZeneca vaccine wey dem collect no follow for di batch wey dey worry some European kontries.

Some European kontris - and recently Thailand for Asia - don march brake ontop using dis brand of vaccine after reports comot say e dey cause blood clot as side effects.

Di National Primary Healthcare Development Agency [NPHCDA], wey dey in charge of di vaccination program for Nigeria, say although investigation don begin to see whether di batch wey arrive di kontri on 2 March get dis particular side effect, dem dey confident in di clinical testing wey rule say di vaccine dey “safe and effective”.

For Nigeria, di president Muhammadu Buhari and di vice Yemi Osinbajo, some state governors and front-line health workers, don already collect di vaccine.

World Health Organization [WHO] on Monday beg kontris across di world not to pause Covid vaccinations, as several major EU kontris stop di rollouts of di Oxford-AstraZeneca jab.

WHO say no evidence dey wey get link between di vaccine and blood clots.