No-fly-zone meaning: Buhari declare Zamfara 'no-fly zone' sake of insecurity palava for di state

Wia dis foto come from, Government of Nigeria
Nigeria President Muhammadu Buhari don declare say Zamfara State na no-fly-zone sake of insecurity palava.
Di President also approve di ban of all mining activities inside Zamfara state in order to stop di increase rate of insecurity inside di area.
National Security Adviser, Major General Babagana Monguno (rtd) na im announce di decision of Nigeria goment give tori pipo afta di national security council meeting wey President Buhari preside over for Presidential Villa, Abuja.
Dis dey happun afta di girls wey gunmen bin kidnap from one boarding school for Jangebe inside Nigeria north-western state of Zamfara regain dia freedom.
General Monguno also tok say all non-state actors don dey placed under surveillance as Federal Government no go waste time to use all means to bring back normalcy inside di kontri.
E say Nigeria defence and intelligence organization don dey on alert and receive order not to allow di kontri enta inside state of confusion.
Oga Monguno say during di meeting, President Buhari give marching order to di new service chiefs to reclaim all areas under di control of bandits, insurgents, and kidnappers.

Wia dis foto come from, Nigeria government
Before now, President Buhari don bin do meeting for early February with Zamfara State Governor Mohammed Mattawalle for State House inside Abuja.
End of Di one wey oda users dey read well well
Afta di meeting, di governor meeting tell tori pipo say di president na im summon am come over to presidential villa so dat e go brief am about security situation inside estate.
Mattawalle add say 358 special police forces na im federal goment don deploy go di state to tackle banditry.
Wetin be No-fly zone
No -fly zone na area over which aircraft dey forbidden to fly, especially during conflict.
No-fly zone, wey also be no-flight zone, or air exclusion zone, na territory or area wey military power don establish wey no permit pipo to fly.
Authorities dey usually set up such zones for di territory wey di enemy for get power well-well during conflict.
Di state wey dey enforce di No-fly zone order fit shoot down Aircraft wey disobey di law by the depending on di terms of di No-Fly Zone












