Delta State University: Governor Okowa establish "University of Delta, UST, DOU" add to DELSU Abraka

Delta State University

Wia dis foto come from, Other

Delta State wan break record as di only state for Nigeria wey own four state universities.

"Dennis Osadebay University, Anwai; University of Delta, Agbor; University of Science and Technology, Ozoro" na di names of di new big schools Govnor Dr. Ifeanyi Arthur Okowa announce on Thursday 25 February.

Dis universities go add to di already existing Delta State University [DELSU] for Abraka town.

For di announcement to establish di three new universities di govnor say last year, 25,000 Deltans apply for university admission. Out of di 20,000 wey dey qualified, only 4,000 na im get admitted.

Dis na why, today, e sweet im belle to sign into law three Bills for di establishment of new universities inside Delta State.

As we continue to work on expanding di educational sector for our young pipo, na my hope say di creation of new universities go help to consolidate di educational system inside our state, Govnor Okowa add as e sign di law di Delta State House of Assembly approve to establish di three new universities.

"Dennis Osadebay University, Anwai; University of Delta, Agbor; University of Science and Technology, Ozoro"

Wia dis foto come from, Ifeanyi Arthur Okowa

Delta State Nigeria

Delta State - "Big Heart Of The Nation" wey be di state slogan - na oil producing state side Niger Delta region.

Na for August 1991 na im di General Ibrahim Badamosi Babangida military goment create di state.

Before-before Delta State bin dey part of old Bendel State [wey include Edo State] from 1976 to 1991 and old Midwestern State from 1963 to 1976

Di state get e name from the delta of di River Niger sake of e location within di down part di River Niger [Nigeria major river].

Delta State dey divided into twenty five local goment areas wey include Aniocha-North, Aniocha-South, Bomadi, Burutu, Ethiope-East, Ethiope-West, Ika-North-East, Ika-South, Isoko-North, Isoko-South, Ndokwa-East, Ndokwa-West, Okpe, Oshimili-North, Oshimili-South, Patani, Sapele, udu, Ugheli-North, Ugheli-South, Ukwuani, Uvwie, Warri-North, Warri-South,Warri South-West.

About 4.2 million pipo or more na im be di population of Delta State wit Urhobo, Itesekiri, Ijaw (Izon), Isoko and Anioma (Igbo) as di main ethnic groups.

"Dennis Osadebay University, Anwai; University of Delta, Agbor; University of Science and Technology, Ozoro"

Wia dis foto come from, Delta State Government

Wetin we call dis foto, Aerial view of ShopRite roundabout, Effurun, Delta State

Sen. Dr. Ifeanyi Arthur Okowa biography

Sen. Dr. Ifeanyi Arthur Okowa na di current guvnor of Delta State. Im na Ika man wey come from Owa-Alero for Ika North-East local goment area and im na first pesin from Anioma to become guvnor for Delta State.

Dem born am on 8 July, 1959. Im go Medicine and Surgery for University of Ibadan, graduate wit MBBS degree for 1981.

Im first work afta school na wit Bendel State Hospitals Management Board as Medical Officer. Later, im enta private practice as Director Victory Medical Centre Igbanke for 1986.

Delta State Governor Ifeanyi Okowa establish

Wia dis foto come from, Ifeanyi Okowa

Sen. Dr. Okowa start im political waka as secretary for Ika local goment, afta im come become di chairman of Ika North-East local goment for 1991-1993.

Im be Delta North coordinator of Grassroots Democratic Movement GDM, before in later join di Peoples Democratic Party PDP for 1998 wia im work for former Guvnor James Ibori campaign for 1998/1999.

Okowa serve as Commissioner for different ministries; Agriculture and Natural Resources July 1999-April 2001; Water Resources Development April 2001 - May 2003; and Health September 2003- October 2006.

For 2007 im resign as commissioner to contest for PDP Guvnorship primaries. Later dat year, im become secretary to Delta State Goment.

E win Delta North senatorial district election for 2011 under PDP and for 2015, im contest again for Guvnor come win.

Sen. Dr. Ifeanyi Okowa wey be govnor under PDP [Nigeria main opposition party] dey serve second term for office afta e win di 2019 election.