Maiduguri News: Borno state Governor Babagana Zulum tok say 10 die and 47 injure for Boko Haram attack for Maiduguri, di Borno state capital

Wia dis foto come from, GovBorno/facebook
Borno Governor, Professor Babagana Zulum don visit two hospitals on Wednesday, after Boko Haram fighters fired shots from Rocket Propelled Grenades, on wey kill 10 pipo and injure 47 for Maiduguri di state capital.
Di attack wey shele on Tuesday night, come from Kaleri, wey dey for di outside part of Maiduguri, but some of di grenade hit places like Gwange and Adam kolo communities, wey get get plenti pipo for di inner city.
Most of di pipo wey die na for Gwange wey one of di RPG shot land for one children's play ground.
"True true dis na very sad time for di pipo and goment of Borno state, about 60 persons dey affected, 10 of dem don die.
Na long distance shots wey di insurgents use. I believe say dis one na new trend we gats stand up and stop.

Wia dis foto come from, Govborno/Facebook
We don see dis kain tin exactly one year ago." Na so Zulum tok as e carry waka go di specialist hospital and University of Maiduguri Teaching hospital.
Wetin bin happen
Reports bin dey say pipo don die for Maiduguri, di Borno state capital for northern Nigeria after heavy explosion by missiles, but nobodi bin actually conafm causalities.
Pipo wey dey live for Maiduguri bin tell BBC say plenti missiles and gunshots bin dey fired for outside di city.
End of Di one wey oda users dey read well well
Maiduguri na di place wia Boko Haram start and e don dey suffer plenti attacks from insurgents.
Since BH start for 2009, di kata-kata don kpai pass 36,000 people and displace like two million from dia house for di north-east part of Nigeria.
As tins be, di major areas wey di attacks shele don dey blocked by Civilian JTF and di army.
See more photos of victims from di Govnor hospital visit

Wia dis foto come from, GovBorno/Facebook

Wia dis foto come from, GovBorno/Facebook

Wia dis foto come from, GovBorno/Facebook

Wia dis foto come from, GovBorno/Facebook













