Nigeria cryptocurrency trading CBN ban: Elon Musk, oda celebrities wey support Bitcoin, Dogecoin and Ethereum and oda Crypto

Wia dis foto come from, INSTAGRAM
Nigeria Central Bank don memo wey remind pipo say dem don wash hand comot for cryptocurrency and anything wey gatz do wit virtual payment and say make all financial institutions stop dey use am for exchange still dey make pipo tok.
CBN believe say crypto no dey regulated and pipo dey use am do bad tins like money laundering and to sponsor terrorism.
Even though Nigeria no be di only kontri wey dey look crypto with side eye, some celebrities around di world for years now don show support to cryptocurrency as maybe di future currency of di world.
Dis na some billionaires and celebrities wey don show support for crytocurrency
- Bill Gates
Di founder of Microsoft na one di richest pipo for di world and pesin wey like to dey invest well-well. For inside one interview e do for 2014, he say Bitcoin beta pass currency as you no need to dey physically present to make transactions and e dey occur for transactions wey involve large money.
- Elon Musk

Wia dis foto come from, ELON MUSK/TWITTER
Apart from making electric cars and im plan to send pipo go Mars, Elon Musk like to dey tweet often im support of cryptocurrency.
- Lionel Messi
Lionel Messi become di brand ambassador for one Israeli company Sirin Labs for late 2017.
Sirin Labs dey produce di world first crypto smartphone and, according to im Instagram handle, di footballer dey support am.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
- Floyd Mayweather
Ogbonge boxer for inside one tweet for 2017 say im dey spend bitcoins ethereum and other types of cryptocurrency for Beverly Hills. He also say make pipo call am Floyd Crypt Mayweather.

Wia dis foto come from, FLOYD MAYWEATHER/TWITTER
- Mike Tyson
Mike Tyson produce Bitcoin ATMs, he also launch Bitcoin Wallet in collaboration wit Bitcoin Direct wit di same branding as di ATM.
- Gwyneth Paltrow
Paltrow na another advocate of crypto — in fact, she be di face of bitcoin wallet, Abra, and she dey advise pipo on crypto.

Wia dis foto come from, GWYNETH PALTROW/TWITTER
- Snoop Dogg
Although e no clear how many albums he sell, Snoop Dog dey sell for Bitcoin
Based on bitcoin value today, he fit don earn roughly $1,000 per album. Di artists also appear for one XRP Community Night crypto party, according to di Coin Shark.














