COVID-19 vaccine: Why WHO remove Nigeria for Pfizer-BioNTech vaccine sharing formular- FG

Wia dis foto come from, M. BUHARI
Di Nigerian goment say di World Health Organisation fail to shortlist am for di Pfizer vaccine no becos e no get facility to store di vaccine but sake of di death rate of di virus for oda African kontris dem.
Di oga kpata-kpata of Primary Health Care Development Agency, Faisal Shuaib yarn tori pipo dis one for Abuja as e dey try deny local tori say WHO disqualify di kontri.
Di WHO -led COVAX global initiative bin choose Cape Verde, South Africa, Rwanda among di first kontri to get di first doses of di vaccine.
Nigeria bin don announce and ready to receive 100,000 doses of di vaccine sometime for end of January or early February but for last minute, di WHO change dia mind plus formular on top which kontri deserve di vaccine pass.
Oga Shuaib say di reason why di world health body choose dis oda kontri na sake of di number of new cases, di trend in di number of cases, di population of di kontri and di availability of di cold chain equipment.
E further explain give say kontris like South Africa wey get di Pfizer allocation na sake of say dem get new strain of di Covid -19 virus and di number of death dey high for di kontri.
And for Cape Verde and Rwanda, di kontri dey small and even di few doses wey dem go give dem, e go epp dem well well pass Nigeria.
Di world Health Regional Director, say for Africa, Nigeria bin dey among di nine kontris for di continent wey suppose get di Pfizer vaccine, but unfortunately, e no come dey easy to give all di 51 kontris wit di Pfizer doses as e no go achieve di desired result.
End of Di one wey oda users dey read well well
E say even though Nigeria no get di initial 100, 000 doses of di Pfizer vaccine, e go get di 16 million AstraZeneca doses sometime for February.
And dat one go cover more population pass di Pfizer one.
Di AstraZeneca/Oxford vaccine still dey under review but di WHO representative assure say di result go come out soon.
'WHO no fit disqualify Member State to get approved vaccine' - WHO Representative
World Health Organisation representative, Dr Kazadi Mulombo don react to di tori wey dey circulate say di Health join-bodi 'disqualify Nigeria and eight other kontris from vaccine bid'.
One local tori newspaper, Sahara Reporters bin report say di World Health Organisation-led COVAX global initiative don fail to shortlist Nigeria for di Pfizer vaccines afta di kontri no gree meet di standard requirement of storing di vaccines at di required -70 degrees Celsius.
Dr Kazadi enter twitter to react to di news say WHO na part of Covax facility and dem no fit disqualify any Member State to access an approved vaccine for dia population.

Wia dis foto come from, Tweet
Dr Kasadi mention say di World Health organisation go make sure say dem distribute COVID-19 vaccines across di world equally and even for Nigeria wey be one of di AMC kontris.
He also mention say Nigeria dey set to receive its first share of di vaccine dis month.
Meanwhile members of di National Primary Health Care Development Agency and di WHO kontri representative dey meet for di kontri capital, Abuja, on Saturday for one emergency meeting.
Di Nigerian goment bin tok say dem dey expect to receive 100,000 doses through di COVAX initiative, wey dem set up to ensure rapid and equitable access to COVID-19 vaccines for all countries, e no matter di income level.
Nigeria Minister of Health, Osagie Ehanire, tok for one press conference for December 2020 say goment dey reason which type of di vaccines to buy because of how dem go take preserve am due to dia low temperature requirements.
"We sign up for advance market participation in COVAX. So if we dey able to get our own, I think e go be for January. But two types of vaccines dey. Di ones dey wey suppose dey ultra deep freezers - di MRA type of vaccines. Dat is di freezer suppose be minus 80 degrees.












