Deeper Life school saga: Wetin Pastor Kumuyi and calls for justice for di schoolboy trend dey about

Deborah Okezie

Wia dis foto come from, Facebook/Deborah Okezie

Read am in 2 mins

Social media for Nigeria don catch fire as kontri pipo dey demand justice for one secondary school boy wey im school senior boys allegedly sexually abuse.

Di boy na 11 years old JSS 1 student of di Deeper Life High School for Akwa Ibom state south-south Nigeria.

Im mama Deborah Okezie bin do video wia she allege say senior boys for di Deeper Life High School bin molest am just two months afta im join di school.

Different hastags like #justicefordondavis #deeperlifehighschool and Pastor Kumuyi don begin dey trend for Facebook and Twitter.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Inside video wey Deborah Okezie bin post for Facebook on December 19 but later remove, she interview her pikin.

For di video, di pikin say dem remove am from junior hostel becos im dey piss for bed, cari am put for SS1 and SS2 hostel. Im say for di hostel "dem dey remove my boxers den push dia hand and leg inside im anus."

Di boy add say, dem no dey give am food and dem threaten am say, "If im complain e go be dead man."

Di ministry of education for Akwa Ibom bin start to investigate di mata after di state goment order dem on 20 December to begin investigation into Mrs Deborah allegations.

According to wetin madam Deborah tok for anoda video wey she do on December 24, di state commissioner of education invite her to im office wia she claim say dem almost beat her inside di office den threaten her to remove di video by force.

But for goment press statement wey di state commissioner for information and strategy sign, dem say "e no get any time wey di commissioner for education or any staff of di state goment, harass or intimidate di parent of di affected student, or anybody we dey connected to di mata."

Meanwhile, principal of di Deeper Life High School, Ndidi Solomon, confam to BBC Pidgin say she don chop suspension but she no gree comment on any question as she say goment don take ova di mata.

Discharge from hospital

Afta im spend days for hospital dey receive treatment, madam Deborah tell BBC say dem go discharge di boy tomorrow.

Di mama promise pipo say she go do anoda video so dat di boy go "tok to di whole world witout me toking for him."

Wen BBC tok wit Deborah to ask her wetin she want for her pikin, she say her lawyer dey on top di mata and "right now I no fit say much... make justice prevail."

Deborah Okezie say she want justice for her son for evri oda pikin wey don suffer similar tin wey her pikin suffer. She say many oda parents don reach out to her say similar tin happen to their pikin but dem dey fear to come out come tok, but she dey hope say di justice she go get for her son go also prove to dem say somebody come out come fight for dem.