Chico Ejiro: ''You die for my hands Chico, you leave me so confused and devastated''

Wia dis foto come from, Joy Chico-Ejiro / FACEBOOK
Wife of di Nollywood producer Chico Ejiro, Joy don desccribe di death of her husband as devastating.
Joy Chico Ejiro for one long Facebook post, say di death dey shocking to am as dem two bin get lot of plans for Christmas .
She say :"we tok a lot about how di day go waka, we bin dey recount how God don dey good to us dis year and how grateful we dey to be alive,
I no sabi say dis go be my last midnight gist wit you. You die for my hands Chico, you leave me so confused and devastated."
For di post she reveal say dem two don dey together for 26 years, she say Chico Ejiro na selfless man who don always be wonderful husband and great father.
Chico Ejiro pass away from seizure for di early hours of Christmas day.

Wia dis foto come from, Joy Chico Ejiro Facebook
Chiko Ejiro, Nollywood Film Producer Die for Christmas Day
Nigerian veteran movie director, screenwriter, and producer, Chico Ejiro don die.
Na for di early hours of Christmas day, im pass away from seizure.
End of Di one wey oda users dey read well well
Local media dey report say Chico just finish directing im new movie for Christmas eve.
Ejiro get hand for many many film for di Nigeria movie industry like Silent Night 1,2,3, Ashanti and 100 days in the Jungle.
How Nollywood celebs react to di news of Chico's death
Plenti celeb don enta social media to express dia sadness at Ejiro passing.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3
Here be some oda tins you no know about di late Chico Ejiro.
- Im bin actually study agriculture for Obafemi Awolowo University wia im first get Diploma, and den di Federal University of Agriculture, Umudike become e move into movie production.
- Im be di younger broda of Nollywood legend, Zeb Ejiro and dem nickname am 'Mr Prolific' because e dey always turn own movies.
- Im be di owner of Grand Touch Pictures wey be production company. Im direct over 80 movies within five-year period.