You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Zlatan Ibile: 'I do bricklayer work before I blow'
Nigerian musician Zlatan Ibile wey make di Zanku dance popular tori how e take enta music.
E tell BBC Pidgin say e don do plenti tins for im life before im blow.
Oga Zlatan don drop one album wey im call Zanku and EP wey im call RoadToCDK.
E discuss some of im music process and also wetin im go do if dem vote am as Nigerian President.