ASUU strike update: Academic Staff Union of universities latest on when schools go resume

Wia dis foto come from, FESTUS KEYAMO/TWITTER
Di Academic staff union of universities for Nigeria, ASUU, say dem go conclude dia consultation dis week by God's grace and dem go notify goment so dat dem go meet.
ASUU begin consult wit all im organs on top di new offer wey goment propose to dem afta dia last meeting wey hold on di 27th of November.
For di negotiating table, goment promise to pay di lecturers dem dia salary but beg dem make dem resume first - but di lecturers say no alert no school.
Dem say make goment no expect dem to resume work without releasing dia salary.
Di Union bin complain say goment bin withhold dia salary sake of say dem refuse to join di IPPIS pay system wey goment introduce.
"E dey important to know say government dey owe our members the arrears of unpaid full salaries for all federal universities from July 2020 to October 2020 (four months); arrears of unpaid salaries to some members for University of Maiduguri (UNIMAID), Michael Okpara University of Agriculture (MOUAU) and some Federal Universities from February 2020 to June 2020 (five months)," ASUU zonal coordinator, Olusiji Sowande yan.
Di national union say goment bin give dem timeline to pay dia salaries and dem di monitor di process and dat once di timeline expire dis week, dia members go take final decision.
Dem also yan say if goment no pay dia salary dem no go fit resume work sake of say dem no trust di goment promise anymore.
End of Di one wey oda users dey read well well
Goment delegation and ASUU don meet reach seven times to find lasting solution to di strike wahala and allow student to go back to school.
Di union bin go strike for March dis year to pressure goment to equip public university wit better facilities and infrastructure so dat student go learn well and compete wit di best for di world.
Dem also bin dey demand for all dia allowance wey dem don work for wey goment no wan pay dem.
And di third thing na dia salary wey goment dey owe dem.
For di eight month wey di strike don last, both goment delegation and ASUU leaders don meet seven times and dis na some of di conclusion from di meetings.
- Di union want goment to pay 110 billion for revitalisation moni but shift ground to 55 billion but goment say e fit pay only 30 billion
- Goment say dem go pay dem 40 billion allawee wey dem dey call earned allowance wey goment dey owe dem
- Di goment also agree to take dem from IPPIS and put dem for dia own payment system wey dem dey call UTAS wey goment still need to verify and approve.
- On dia salary, goment don agree to pay dia salary through dia old system.
- From di last meeting di total moni wey goment don offer ASUU on top dia revitalisation moni, wey be di moni for repair of di school plus earned allowance na 70 billion Naira.
Wetin come still dey hold ASUU?

Wia dis foto come from, OTHER
One of di offer wey goment give wey no sweet ASUU for belle at all na di moni to take equip di universities dem.
BBC Pidgin find out say members dey para sake of say dem say plenti of di universities for Nigeria no get beta facilities
Dem say dem no get beta lecture hall, no light and even some no get chairs.
Dem complain say di hostels bad sotey -e dey even shock dem say student dey stay inside and dat di moni wey goment dey propose no go fit make Nigerian universities stand out.
Secondly, on dia salary wey goment neva pay, dem say goment dey ask dem to go back to class before dem pay dem, dem say dat one no go dey possible sake of say,
dis goment no dey sincere and e don show ASUU say dem no keep to dia promise.
" Ngige bin dey wen we enta agreement for 2017 and 2019 and till date, e no fulfil any of di agreement and so we no fit trust dem" one of di leaders of ASUU tell BBC Pidgin.
Di lecturers say dem want goment to pay dia salary if e dey ready and serious to end di strike.

Wia dis foto come from, FEDERAL MINISTRY OF LABOUR
School fit resume dis year?
E neva dey clear wen public universities go open dia doors to students
Sake of say both goment and ASUU still get mata wey dem neva agree on.
Di next meeting na Friday 4th of December and di outcome of dat meeting go really show how ready both party dey to resume school.
Since di establishment of ASUU for 1978, di union don go strike for different reason to pressure goment to meet dia demand.
For 1988, 1992,2007,2008,2009,2013,2017,2019 and 2020 di unions go on strike but dis time, dem say if goment no do di right thing, dem no go go back to class.
We don update dis tori












