Newspaper vendors demand justice for Ifeanyi Chukwu wey Femi Gbajabiamila security aide 'shoot' dead for Abuja

Di vendors dey protest
Wetin we call dis foto, Di vendors dey protest

Newspaper vendors dey protest di death of one of dia colleague, Ifeanyi Chukwu for di Federal Capital Territory, Abuja.

Dis wan na afta gunshot from di security aide of di Speaker of di House of Representatives touch and kill di vendor on Thursday, 19, November, 2020, for di Federal Secretariat area, around 3:00pm as dem surround di speaker convoy as e dey comot from office.

Di vendors say di protest na to call di attention of di speaker and di IGP of police.

Dem also say dem no go distribute any paper until 10 am local time and if any paper try leak any paper out, dem go sanction dem.

Dem start di protest from area one.

Di vendors dey protest

Ifeanyi sister wey follow the pip wey protest say her brother na pesin wey no get problem.

"E no be tiff, e no be armed robber, e dey road dey hustle for imsef and family, dem shot am die. Na my broda, e no get broda, dem shoot am down unnecessarily." She tok

Ifeanyi Elechi

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Ifeanyi Elechi

Some of di vendors carry placard dey ring bell dey sing "all we are saying, give us justice!"

One of di vendors wey speak with BBC Pidgin say Ifeanyi wife just born before dis incident happen.

Dem bin dey prepare to do naming ceremony for im pikin on Friday, instead na protest to demand justice for im death dem dey do.

Vendors protest

Meanwhile di speaker of di House of Representatives, Femi Gbajabiamila don suspend di officer from im convoy wey shoot and kill di newspaper vendor.

Di speaker say e go dey suspension until police conclude dia investigation.

Ifeanyi kpai afta di speaker security aide shoot am for head

E die shortly afta dem rush am go National Hospital for Abuja.

Speaker of di House of Representatives, Femi Gbajabiamila

Wia dis foto come from, Femi Gbajabiamila

Wetin we call dis foto, Speaker of di House of Representatives, Femi Gbajabiamila

How e happun

Gbajabiamila wey describe Ifeanyi death as horrific say im bin comot office and come stop over by di newspaper vendor pipo dem to greet dem as usual.

According to am, e get special relationship wit di vendors dem as many of dem don know am since e enta Abuja. Sake of dis, di speaker get di habit to di give dem moni anytime wey e pass.

And so, Ifeanyi and some oda boys dem bin come surround di speaker convoy as per sey dem see am as friend to get dia own share for di day, but unfortunately dem come hear di gunshot.

Oga Gbajabiamila explain say, afta e greet di vendors dem and ready to move, some unidentified men come block di convoy and dis one come make di security pipo dey alert and dem begin shoot for air.

"Di security pipo say dem apply dia security sense and discretion as dem fire for air" im yan.

E say wit di info, im believe say notin happun but hours later, afta dem reach dia destination, dem come get info say one man die from stray bullet.

Di Speaker wey describe Ifeanyi death as horrific, sympathise wit di family.