Jerry Rawlings: Ghana former leader Jerry Rawlings don die

Wia dis foto come from, Getty Images
Jerry Rawlings, Ghana former leader don die afta short illness.
Rawlings die on Thursday morning from heart attack.
Jerry Rawlings John AKA J.J.Rawlings dem born am 22 June, 1947.
E die at di age of 73 for Korle Bu Teaching Hospital.
Former Prez. Rawlings death dey happun just less than a month to di 2020 Ghana presidential election.
Before im death, former Prez. Jerry Rawlings bin dey support former Prez. John Mahama re-election plan for di 7 December election against current Prez. Nana Akufo Addo.
Liberia President George Weah wey also confam Rawlings death tweet say: "Ghana, Liberia and Africa go miss a great leader."
Mahama suspend campaign for [Jerry Rawlings death]
Presidential candidate of di National Democratic Congress (NDC), John Dramani don suspend e six-day campaign tour of di Ashanti region wit immediate effect.
End of Di one wey oda users dey read well well
According to statement e campaign team release, dis na becos of di news of di death of Jerry Rawlings.
Di campaign team describe am as "iconic figure and founder of di NDC".














