Pope Francis say Homosexual pipo get di right to be in a family

Pope Francis

Wia dis foto come from, Reuters

Pope Francis don give go ahead for same-sex civil union for di first time.

Pope tok during one interview for di feature-length documentary "Francesco."

"Homosexual pipo get di right to be in a family. Dem be children of God," Francis tok.

Pope Francis become di first pontiff to endorse same-sex civil unions inside comments for one documentary first land alias premiered Wednesday.

Wetin we call dis Video, "If a person is gay and seeks God and has good will, who am I to judge?"

Di decision spark cheers from gay Catholics and demands for clarification from conservatives, knowing di Vatican official teaching on di issue of same sex marriage.

As e bin dey tok for one television program called Francesco released inside Rome, di pope say same-sex couples get di right to be togeda and dia lives no suppose dey inside in a situation.