Trump positive for Covid 19: Afta "Hope Hicks" coronavirus, Donald Trump tweet say Melania & POTUS test positive to di virus

Wia dis foto come from, Reuters
Plenti pipo don come out to wish America president Donald Trump and di first lady quick recovery afta im tweet dis early morning say im and im wife test positive to coronavirus.
Im personal doctor Sean Conley say di presido and im wife dey fine and he go continue to work from house.
Tori be say Donald Trump and First Lady Melania Trump don test positive for coronavirus and dem dey quarantine.
Di president announce di tori for inside tweet post on Friday morning.
Dis dey come afta one of Oga Trump closest aides test positive for coronavirus.

Wia dis foto come from, AFP / Getty Images
Hope Hicks, di 31-year-old adviser to di president, na di closest adviser to Oga Trump to test positive so far.
She travel wit am on Air Force One for one TV debate for Ohio earlier this week.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Earlier, oga Trump say im and im wife go begin quarantine after Ms Hicks test positive.
End of Di one wey oda users dey read well well
He tweet for Thursday night: " "Hope Hicks, don dey work very hard without taking even if na small break, just test positive for Covid 19. Terrible!
"Di First Lady and I dey wait our own test results. For now, we go begin our quarantine process!"
E neva clear how di quarantine go affect arrangements for di second presidential debate, which go hold for 15 October for Miami, Florida.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di 31-year-old adviser to di president na di closest adviser to oga Trump to test positive so far.
She travel wit am on top Air Force One for di TV debate wey hold for Ohio earlier dis week.
Foto as Ms Hicks comot di presidential jet on Tuesday for Cleveland without mask dey.
She even siddon very close to am inside di presidential helicopter Marine One on Wednesday wen di president do rally for Minnesota.

Wia dis foto come from, Reuters
E don get any oda cases of covid 19 virus for White House?
Ms Hicks na di latest White House aide to catch Covid-19. Vice-President Mike Pence press secretary Katie Miller bin test positive for May and don recover.
That same month, one member of di US Navy wey dey serve as one of oga Trump personal valets test positive for coronavirus.
But di White House say neither di president nor vice-president dey affected.

Wia dis foto come from, Getty Images
National Security Adviser Robert O'Brien, some Secret Service agents, one Marine One pilot and one White House cafeteria worker also test positive.
Ms Hicks na di campaign tok-tok pesin during oga Trump candidacy before she become im communications director for di White House.
She step down for March 2018 to become chief communications officer at Rupert Murdoch Fox, before she return to di White House for February.
Coronavirus don infect more than 7.2 million Americans, killing more than 200,000 of them.
Di White House always dey test aides and anyone else wey come in contact with di president everyday.
Who be Hope Hicks?

Wia dis foto come from, EPA
- She grow up for Greenwich, Connecticut
- Start modelling as a teenager and bin do advert for Ralph Lauren once
- She bin work for one public relations company wey handle Ivanka Trump fashion business and di Trump Organization property brand
- he join Trump Organization for 2014 and Donald Trump carry am enta im campaign team a year later, despite her lack of political experience
- Nicknamed "Hopester" by ogaTrump, she is said to be one of im most trusted adviser and among di few who fit make am change im mind about something.













