Covid-19: UK begin £10,000 fine, see oda kontris wia rules breaking go cost you

Policeman dey wit two women during lockdown for Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

On Monday, UK go begin nack fine up to £10,000 ($12,700) ontop anybodi wey refuse to self-isolate. But no be only dem get fines for Covid-19 rules breaking.

As kontris around di world dey try find way to reduce di Covid-19, e don become necessary for goment to bring serious measures to make citizens comply wit safety rules and guidelines.

Make we torchlight some kontris wey get 'Covid-19' fines from di small to di big money.

Rwanda

Earlier in September, Rwanda announce say for di capital Kigali pesin wey no wear im face mask well-well go pay $10 fine. Di same amount valid for pesin wey break social distancing rules for public, or disobey night-time curfew.

But, di money rise shaparly fo $200 for organisers of parties and oda illegal gatherings; and those wey attend go need find $25.

Wetin we call dis Video, President Cyril Ramaphosa struggle to put on face mask

Nigeria

Although di West Africa kontri no get fixed amount to use fine pipo, di court fit nack fine ontop anyone wey break safety rules.

One popular case na that of Nollywood actress Funke Akindele and her husband Rasheed "JJC Skillz" Bello, wey chop 100 thousand naira fine each (wey pass $250USD) because dem organise house party during lockdown.

Funke Akindele

Wia dis foto come from, JJC Skillz/ Twitter

Wetin we call dis foto, Funke Akindele na one of Nigeria best actresses

South Africa

For South Africa, you need to think twice before you go lie onto pesin head say e get Covid-19, because na offence wey attract R3000 ($175) fine.

And R5000 fine dey wait anybodi wey expose im fellow citizen to di virus on purpose.

Women dey try adjust mask

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For Rwanda, e dey important to sabi how to wear face mask di right way as fine of $10 dey wait pesin wey no do am well

India

Even if pesin dey inside vehicle but e no wear mask for Delhi, India, na Rs 500 ($7) on-the-spot fine di pesin go pay. Say you wan go find di money no dey di tori at all.

Police women for India dey write fine for man inside car wey no wear face mask

Wia dis foto come from, Getty Images

Spain

Di minimum fine for pesin wey no gree do stay-at-home na 601 euros ($700), and di punishment fit increase in line wit how di offence serious.

For instance, if pesin go hold party during lockdown, di fine fit reach 10,400 euros.

For April, one man for Logroño, La Rioja region chop fine from police because e carri "im goldfish for stroll".

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Saudi Arabia

Many kontris dey learn work wia Saudi Arabia dey - as far as fines dey concerned. As at May 2020, break quarantine rules for Saudi Arabia and you fit pay reach 200,000 riyals (over $53,000) or face prison for two years, according to online reports. Although, by September e be like say e don drop to 10,000 riyal ($2,600).