NDC Manifesto: John Mahama promise Ghanaians one million jobs, okada legalisation - See other key things wey dey di 2020 declaration

John Mahama

Wia dis foto come from, John Mahama/Facebook

Ghana opposition National Democratic Congress (NDC) yeste launch dema Election 2020 campaign manifesto which more people dey talk about.

De manifesto wey dem describe as, 'The People's Manifesto: Jobs, Prosperity and More' highlight de various promises wey Flag bearer John Dramani Mahama want execute if Ghanaians give am de mandate.

Out of de plenty promises, here be top eight promises which dey interest more people for Ghana.

Free SHS for private schools

Free Senior High School education be one of de major interest points for Ghanaians.

Under current NPP government, all SHS students for public schools dey enjoy free education, but according to de NDC dem go extend dis provision to cover private schools.

Running mate of de party, Professor Naana Jane Opoku-Agyemang, explain say de next NDC Government go make Free Senior High School Programme better by so say e go cover students wey dey private Senior High Schools for underserved/deprived areas.

Dem also add say dem go abolish de double track system where students dey go school in two batches dem expand infrastructure so say schools go fit accommodate.

John Mahama and running mate Jane Naana Opoku-Agyeman

Wia dis foto come from, John Mahama/Facebook

Wetin we call dis foto, John Mahama and running mate Jane Naana Opoku-Agyeman

Absorb 50% of tertiary school fees

According to de NDC, dem go absorb 50 percent of school fees for all tertiary students if Ghanaians vote dem into power.

Professor Naana Jane Opoku-Agyemang, running mate of de NDC, reveal during de launch.

She explain say dis policy go take effect with immediate effect when NDC win power.

Agenda one million jobs in first term

Unemployment be major challenge wey dey face Ghanaian youths.

But de NDC Flag bearer, John Mahama say in de first term of en government he go create one million sustainable jobs if dem come power in 2021.

Dis according to him go address de challenge of joblessness among graduates for de country.

Dem san add say instead of temporary jobs for de youth, de jobs dem go create go be sustainable jobs to support de livelihood of Ghanaian youth.

Retain NABCO beneficiaries

NDC also add say dem retain all NABCO beneficiaries who dey job for various places dem give dem better salary.

Currently, de NABCO employment scheme wey NPP introduce be temporary, but according to NDC during dema time beneficiaries for dis program top go enjoy full employment plus better rewards.

President Nana Akufo Addo and John Mahama

Wia dis foto come from, Facebook /Nana Akufo-Addo

Wetin we call dis foto, President Nana Akufo Addo and John Mahama

Scrap law banning salvaged vehicles

Opposition leader of NDC for Ghana reveal say govment go scrap de ban on importation of salvaged vehicles if he come power in 2021.

He explain say dis move go help improve de lives of Ghanaians wey dey operate within de local automobile industry.

Four-month maternity leave/7-day paternity leave

Opposition National Democratic Congress (NDC), also reveal say dem go extend de regular three-month maternity leave wey women dey enjoy to four months if dem come power.

In addition to dis, dem go give men 7 days paternity leave too so say dem fit support dema spouses.

John Mahama

Wia dis foto come from, SIA KAMBOU

Tax incentives to landlords to reduce rent advance

NDC also promise Ghanaians say dem go elevate de office of Rent Control to Rent Authority so say de institution go get more powers to operate.

De issue of rent advance be major challenge for most Ghanaians, but according to de NDC, dem go give landlords some tax incentives which go make de cost of rent drop when dem come power.

John Mahama explain say landlords, real estate investors and tenants go jointly review de Rent Act to provide tax incentives to landlords den real estate investors.

According to him, dis go reduce de cost of rent advance for residential and commercial purposes.

Legalise and Regulate Okada business

Opposition NDC make am official to Ghanaians say if dem come power in 2021, dem go legalise den regulate okada business for de country.

Dem explain say dis go allow make sanity enter de transport sector especially for bikers and safety of road users at the same time.

According to de NDC, legalisation and regulation of de business go provide more jobs for those interested and go help generate income through payment of taxes to the government.