Kogi supreme court judgement: Election tribunal wey Gov. Yahaya Bello win for Kogi State dey legit

Kogi supreme court judgement

Wia dis foto come from, YAHAYA BELO/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Supreme court don troway PDP appeal for Govnor Yahaya Bello
Read am in 2 mins

Kogi State supreme court judgement don pass verdict say Yahaya Bello win 16 November, 2019 governoship election.

Supreme Court for Nigeria on Monday troway di petition wey di Peoples Democratic Party appeal to challenge di victory of Govnor Yahaya Bello afta months of legal case from election tribunal and appeal court.

Di seven-man panel wey di Chief Justice of Nigeria, Justice Tanko Muhammad lead affirm Bello election on di platform of di All Progressives Congress.

For di lead judgement, Justice Uwani Abba -Aji say di supreme court agree wit di earlier July 4, 2020 judgment wey Court of Appeal give for Abuja

And di May 23, 2020 majority verdict wey di election petition tribunal, give and all of dem declare Bello winner.

Di highest court resolve all di five issues and complain wey di PDP and im candidate, Musa Wada bring come court in favour of governor wada.

Kogi supreme court judgement

Wia dis foto come from, YAHAYA BELLO/FACEBOOK

Di court say all dia complain no hold water and e dey lack in merit.

"Afta we don resolve all the five issues against the appellants, e dey clear say di appeal no get merit and we don dismiss am', the court ruled.

Aside from di CJN, Justices Okoro and Abba-Aji, and oda members of di panel wey agree wit di judgement be Justices Olabode Rhodes-Vivour, Sylvester Ngwuta, Kudirat Kekere-Ekun, and Amina Augie.

Wetin we call dis Video, Kogi Election: We no ready to sell our votes dis time-Kogi women

Di Supreme Court also throway di appeal file by Social Democratic Party's candidate, Natasha Akpoti, against di election of Governor Yahaya Bello.

Natasha bin cry go di highest court to ask am make e set aside di judgement of di lower court wey bin declare govnor Bello winner of di November 16 govnorship election.

Natasha bin say di election bin get wuru-wuru plus dem no follow electoral act but di Supreme court say SDP candidate no fit prove beyond any doubt say di election get wuru wuru.