Boko Haram attack: Borno State Governor dey hala while North Cameroon, Maiduguri Nigeria border bloodbath happun for Nguetchewe village

Wia dis foto come from, L’oeil du Sahel
Justs days afta suspected militants from Islamist group Boko Haram bin attack Borno State Govnor Prof. Babagana Zulum, Nguetchewe for Mayo Moskota, inside Mora near border wit Nigeria di craiy 16 pipo weh deh die afta suspected Boko haram attack de camp, also wound seven.
Deh attack happen for Sunday morning happen inside camp for displaced pipo (IDPs) for dis area.
De attackers throway grenade for pipo weh deh bi di sleep inside camp, Medjeweh Boukar Mayor for Nguetchewe village tell Reuters. De camp na home for about 800 pipo Mayor add.
Villagers tell Boukar say 16 pipo die, but security officials say na 15 and de pipo weh deh wound dey for hospital.
Cameroon health minister, Manaouda Malachie confirm say hospitals bi flop wit die bodi and pipo weh wound, inside tweet for night.

Wia dis foto come from, L'oeil du Sahel
Mayor say "deh attackers kam wit woman weh e hold grenade. Woman and pikin dem dey among de pipo weh deh die".
For de past months, dis camp don suffer about 20 attacks, Boukar dok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Na camp for IDPS weh deh run Boko Haram attacks from oda parts for Far North region, and e dey under care for United Nations High Commission for Refugees. De only informate weh UNHCR get for now na from media and pipo. deh plan for visit de area tomorrow for get first hand informate.
End of Di one wey oda users dey read well well
For June last year, about 300 suspected Boko Haram militants bi enta Lake Chad area for Far North Cameroon kill 24 pipo, some soldiers for military posts.
About 30,000 pipo don die from attacks weh deh force millions for run enta Cameroon, Niger and Chad.
Boko Haram don di fight for ova ten years for form Islamic caliphate for Nigeria.











