Third Mainland Bridge closure date: Lagos residents para ontop traffic, transport fare as TMB close for repairs

Third mainland bridge
Read am in 3 mins

Vehicle owners, commuters and odas for Lagos state don begin cry say suffer too much for road sake of di closure of di Third Mainland Bridge wey take effect from midnight Friday, 24th July.

Most of di complains from Lagosians be say transport fare come increase, traffic come plenti pass before and trailers still block di small road wey motor suppose pass as di goment close Third mainland bridge for repairs.

Di Federal Ministry of works and Housing bin announce say dem wan carry out Routine maintenance on di Third Mainland Bridge, wey be Africa second longest bridge and so dem go close am six months.

3rd Mainland Bridge

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI

Wetin we call dis foto, Na di bridge most pipo dey follow go work for Lagos State

For early mor-mor today, Our tori pesin wey carry waka go Third Mainland Bridge say Vehicle still dey move on di third mainland bridge coming from di Island to di mainland but no traffic dey dia because many motor take di alternative route dis morning.

Third Mainland Bridge
Third Mainland Bridge
Third mainland bridge

Presently, di route wey be from mainland to island inside di third mainland bridge don dey open for vehicle to use.

How pipo dey cope?

Daniel wey be lawyer tell BBC pidgin say im leave e house dis morning around 5:30am for a journey of 15 minutes and e still dey on di road as at 7:00am. E say e even park im motor for Stadium come dey trek sake of di way trailer don block road for Constain side and add say e must be in court by 9:00 o'clock.

Concerning di water route wey Lagos goment advise pipo to dey use, Barrister Daniel say im route no dey close to water transport and e no fit use am.

Third mainland bridge

Anoda pesin wey im name na Andrew for Constain roundabout, tok say traffic dey too much especially from those trailer wey dey go Apapa and dis fit make bus drivers increase dia transport fare.

One commuter, Tolu tell BBC say di traffic dey too much and she leave home before 6:00am dis morning. She say transport fare don increase compare to wetin she bin dey pay before.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Dis na how goment say di operation go waka

Third mainland bridge

Dis na di Alternate road for di first three moths (Island to Maniland);

For those wey dey come from Lekki, Ikoyi Obalende and Lagos Island

Di federal goment advice say make dem follow Carter Bridge, to connect to Iddo, to Oyingbo, to Ebute Metta and from dia find dia way.

But dem no go fit use clinic way (through Adekunle) as di whole side of di bridge go dey closed down.

For those wey dey come from Victoria Island and Bonny Camp

Dem go follow Independence bridge to Onikan, to Obalende bridge to Oyingbo to Ebute Metta.

LASTMA

Wia dis foto come from, LASTMA

LASTMA

Wia dis foto come from, LASTMA