Ikoku 4: Ifeanyi Onyekwere share im pain afta alleged torture by di Eagle Crack Squad ex-policemen for Port-Harcourt
Magistrate Court for Port Harcourt don remand four Ex-policemen wey bin dey for Eagle Crack Squad to prison custody for di murder of Chima Ikwunado among oda charges. plus torture on di Ikoku 4: Ifeanyi Onyekwere, Ogbonna Victor, Ifeanyi Osuji and Osaze Friday.
Police authorities don also sack di officers from wey allegedly torture late Chima Ikwunado to death for December 2019.
But Ifeanyi Onyekwere one if di Ikoku 4 say since im dey treat imself for di injury im suffer, im no fit use one of im hand wey get serious wound from di torture im suffer from di E-crack squad hand.
Im come demand for the appearance of di Eagle Crack Squad Commander Benson Adetuyi and di IPO wey charge dem to court on false allegation, Inspector Sam Amadi say dem too must come court.
Oga Ifeanyi bin dey come from Aba, Abia state, go Port Harcourt for Rivers state Nigeria for December 19, 2019 wen im jam Chima Ikwunado, im childhood friend.
Chima wey be mechanic, give am lift, na car wey e bin dey work for im customer. E stop to pick im co-worker along di way, already one boy bin dey di car, meanwhile im boy dey back dey drive anoda of im customer corolla.
"Hold-up plenti for road so we decide to run one way, we bin no know say E-Crack dey follow us, dem later stop say we be armed robber dats why we dey run one-way." Ifeanyi tok.
Dat na di beginning of di ordeal wey keep Ifeanyi and three odas behind bars for over one month and wey sadly claim Chima life.
