Buhari no go address di nation - Wetin go happun next?

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria President Muhammadu Buhari no go deliver any broadcast address to Nigerians ontop Covid-19 today, Monday, 18 May 2020.
Dis na informate from im special adviser, Femi Adesina.
Dis na as many Nigerians bin dey expect to hear from dia presido today, as per report wey don comot before ontop di mata.
Adesina tweet say instead na di Presidential Task Force for Covid-19 go carry dia normal give di president wey im go come share wit kontri pipo.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Yesterday, one press statement bin dey circulate for media say Buhari go give speech ontop coronavirus, and if extension ontop lockdown ease go dey or not.
"We don make our recommendations to Mr. President and we gatz wait for im decision tomorrow." Dr. Sani Aliyu, National Coordinator, di Presidential Task Force on COVID-19 bin tok for one national TV on Sunday night.
Afta Nigeria relax lockdown, put night curfew & travel restriction - wetin go happun next?
Currently for Lagos, di state goment don introduce new initiative wey authorites wan use inspect which church, mosque and place of jolliment dey ready to re-open, as part of di next stage of relaxation of lockdown for Nigeria bizness capital city.
According to di latest report wey Nigeria Centre for Disease Control, NCDC give on Sunday, 5959 pipo don catch di coronavirus inside Nigeria but di coma be say as big as di kontri population dey dis number no mean anytin.
End of Di one wey oda users dey read well well
So na di challenge of how to keep di health of more than 200 million Nigerians safe be di koko and currently di fear be say more pipo no know dia coronavirus status because of say di health equipment for Nigeria never still increase reach wia dem fit test a sizable number of di population in a short time and deay ready to take care of any big emergency.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Earlier for inside Aso Rock wey be di presidential palace, presido Buhari bin receive briefing from Presidential Task Force wey oga Boss Mustapha, di chiamo, plus NCDC DG and di kontri health minister all join-bodi go see am.
We don dey monitor quite closely how pipo dey obey di relax lockdown guidelines and wetin we recommend na in di best interest of Nigerians, Dr Aliyu tell ChannelsTV.
Since 4 May, 2020 wen Nigeria relax di coronavirus lockdown, di kontri release new guidelines wey pipo must follow to reduce di spread of COVID-19 virus but di Presidential Task Force belle no sweet say many pipo dey disobey.
Nigeria health authorities dem believe prevention na di best option for kontri like Nigeria.

Wia dis foto come from, Nigeria state house
Tori be say three major towns for Nigeria: Lagos, Ogun and Abuja don dey total lockdown since 30 March reach 3 May, 2020 wen di president tok say di lockdown dey necessary to reduce spread of coronavirus.
"I don approve for phased and gradual easing of lockdown measures for FCT, Lagos and Ogun States starting from 9:00am Monday 4 May, 2020 ," na wetin di presido tok for im live broadcast.
President Muhammadu Buhari address Nigerians for about 25 minutes from 8PM on Monday 27 April, 2020, as di latest lockdown wey di Nigerian leader order for parts of di kontri dey expire di same day.
President Buhari tell Nigerians di order wey go follow Coronavirus lockdown wey im put since 30 March, 2020 for three major towns across di kontri to stop di spread of Covid-19 disease.










