Prof Ibrahim Gambari don replace Abba Kyari as President Buhari new Chief of Staff

Prof Ibrahim Gambar dey extreme right, wear face mask for inside Aso villa on Wednesday 13 May, 2020 wen Buhari inaugurate am as di Chief of Staff.

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Prof Ibrahim Gambar dey extreme right, wear face mask for inside Aso villa on Wednesday 13 May, 2020 wen Buhari inaugurate am as di Chief of Staff.
    • Author, Olubunmi Okunnu
    • Role, Broadcast Journalist

Nigeria president Muhammadu Buhari on Wednesday reveal Professor Ibrahim Gambari as im new chief of staff.

Prof. Gambari replace Oga Abba Kyari wey im name trend ontop Nigerian social media websites for almost one week afta di goment announce im death on 17 April, 2020.

Secretary to di Goment of di Federation Boss Mustapha na im announce di appointment as di Federal Executive Council wan start on 13 May, 2020.

Ibrahim Gambari

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Prof. Gambari na ogbonge scholar-diplomat wey don hold top-top positions for United Nations
Prof Ibrahim Gambari

Wia dis foto come from, Presidency

Wetin we call dis foto, Secretary to di Goment of di Federation Boss Mustapha na im announce di appointment as di Federal Executive Council wan start on 13 May, 2020.

Dis na wetin you suppose know about Professor Ibrahim Gambari

Prof. Ibrahim Agboola Gambari na ogbonge scholar-diplomat wey don hold top-top positions for di joinbodi, according to informate wey United Nations put ontop dia website.

Make we torchlight who di Prof be.

  • Dem born am for 1944, for Ilorin, Kwara State, north central Nigeria.
  • Gambari attend King's College, Lagos. Im come later attend London School of Economics wia im get im B.Sc. (Economics) degree for (1968) wit specialization in International Relations.
  • Im later collect M.A. (1970) and Ph. D. (1974) degrees from Columbia University, New York, USA in Political Science /International Relations.
  • Prof. bin teach for Ahmadu Bello University, Zaria, Kaduna State 1977 to 1980.
  • First UN Under-Secretary General and Special Adviser to di Secretary-General on Africa.
  • Oga Gambari become Nigeria Minister of External Affairs between 1984 and 1985.
  • E also become Ambassador and Permanent Representative of Nigeria to di United Nations 1990 to 1999.
  • President of di Executive Board of UNICEF in 1999.
  • Head of di UN and AU Hybrid Mission for Darfur (UNAMID) from January 2010 to July 2012.
  • President Jacob Zuma award am South Africa highest honour for non-citizens for October 2012.
  • Na him be di first chancellor of di Kwara State University for 2013.
  • Im na di founder of ogbonge research organisation; Savannah Centre for Abuja.
Prof Ibrahim Gambar dey extreme right, wear face mask for inside Aso villa on Wednesday 13 May, 2020 wen Buhari inaugurate am as di Chief of Staff.

Wia dis foto come from, Presidency

Ibrahim Gambari

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Gambari serve as UN Joint Special Representative, for Darfur

Some of di names wey don come up before as replacement to oga Kyari na pipo like Babagana Kingibe, Adamu Adamu, Hameed Ali and even di current Kaduna governor Nasir el-Rufai.

Wetin Nigerians tok about Gambari appointment

Many Nigerian wey tok wit BBC News Pidgin say dis time wey an academic and diplomat di hold di position for di country, dem hope say e go give di goment sound advice wey go move di kontri forward.

Ambassador Lolo Bitrus, say oga Gambari dey very grounded for im field and as an administrator, e get di competence to serve for dat position.

E say Gambari be im lecturer for university and im work wit am for di Ministry of Foreign Affairs and one quality of Gambari na say e dey level headed and e be man of substance.

Ambassador Lolo further explain say im exposure for di UN go put am for di position to offer sound advice.

" If you look all di pipo wey don hold di position before, you go know say e dey more qualified because e be intellectual and competent diplomat" Lolo tok

Di president of Nigeria Foreign Relations Association, Ambassador Gani Lawal say oga Gambari na very loyal pesin and e be workaholic and e go really deliver as a chief of staff.

E say Oga Gambari be foreign minister under president Muhammed Buhari den under military and dem work tegeda well well.

And dat wen Nigeria former Head of Stae Ibrahim Babangida bin do coup drive away Buhari from power, e ask am make e continue as minister, e refuse di offer because of im loyalty to president Buhari.

E say di kain pesin wey Gambari be, e go do di job wit human face.

Wetin be di work of chief of staff

  • To Coordinate di activities of all di Principal Staff Officers of the President
  • Pass all di message, directives and decisions of di President to the SGF, CDS. Members and oda top goment officials
  • To form ad-hoc bodies and write dia terms of reference togeda wit SGF
  • To lead di meetings of Principal Staff Officers to di President
  • Monitor and Coordinate di day to day activities of the President
  • To clear all official military and civil matters as well as preparation of executives summaries for official mata
  • To arrange for official appointments and engagements of di President, togeda wit SCOP and ADC
  • To arrange all di meetings by di President and ensure coverage of di meeting and provide secretariat services.
  • To organise Federal Executives Council meetings togeda wit di cabinet secretariat
  • To advise di President on top im schedule, meetings schedules.
  • To attend National Defence and Security Council meetings