Coronavirus vaccine: Scientist say "we get for know weti di make pipo well afta deh take Cameroon Archbishop COVID-19 concoction"

Wia dis foto come from, CNA
- Author, Leocadia Bongben
- Role, BBC News Pidgin, Cameroon
Prof Sammy Bebane Choumbo, President of Cameroon Academy of Sciences don tell BBC News Pidgin say e good for know weti di change pipo dia health situation afta deh drink Archbishop Samuel Kleda e merecine.
Cameroon get 1832 cases for Covid-19, second highest for Sub-Saharan Africa, and 61 don die.
Archbishop Kleda confirm e tok for tori pipo dem yesterday say e concoction from leaves
di treat symptoms for Covid-19 for pipo pipo weh deh don bi test positive.
Kleda weh e start treat pipo wit leaves for over 30 years say deh di make give'am de merecine free for de pipo weh deh di sick.
Health Minister, Manaouda bi say e go send experts for shine eye for dis concoction but Kleda tell tori pipo say e di still wait dem.
As mimba for Cameroon Academy of Sciences, Prof. Bebane Chmbou say deh nova shiddon tok laik group but di discuss among dem about Kleda e concoction.
"We di try for contact some of Kleda e doctors for gada informate if we fit do some official clinical trials wit proper protocol so dat we fit get proof say deh merecine di cure Covid-19 signs", Bebane tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
We know say Archbishop Kleda na man weh e bi highly respected, and logical, so e di use experience as proof as e discover say pipo weh deh take de medication don well, e add.
But, e say from science point of view deh get for check weti di make health situation for pipo weh deh take Kleda e merecine change.
"We need for make clinical trials weh deh di follow technique and rules weh science and merecine di use for confirm say de merecine di treat", e conclude.
Last week, the World Health Organization (WHO) bi say proof no dey for show say de merecine for Madagascar, weh dia president launched di cure coronavirus.










