Nigeria lockdown update: Civil servants for Lagos no go resume work immediately - See di new rules pipo must obey from 4 May

Wia dis foto come from, Lagos State Goment
- Author, Gift Andrew
- Role, Reporter, BBC News Pidgin, Lagos
- Read am in 2 mins
As Nigeria president don announce say dem go begin to ease di lockdown for Lagos and Ogun states plus Abuja di kontri capital from today , May 4, to combat Coronavirus Disease (COVID-19), Lagos State Goment don tell all civil servants make dem no resume work immediately.
Governor Babajide Sanwo-Olu, tok dis one for Sunday at di State House. Im say di delay dey deliberate to prevent over crowding of pipo for roads and public places.
But if you dey go back work today or dey waka for public...
Dis na di new rules wey Lagos goment don order
1. Official work hours go be from 9am to 3pm.
2, Offices go dey operate at 60% capacity with infrared thermometer and tins to use do cleaning.
3, Commercial buses go dey operate for 60% capacity. Okada still dey under ban. Boats go dey run from 6am to 6pm.
4, Entertainment and event centres go still dey closed for now. Swimming pools and parks go dey lockdown for di next two weeks.
5, Burials go fit hold but with no more than 20 pipo and dem must maintain physical distance, plus no party after burial.
End of Di one wey oda users dey read well well
6, Curfew go begin from 8pm to 6am.
7, Schools still dey closed.
8, Markets and malls go dey operate from 9am to 3pm.
9, NURTW, NECA, MAN go work with state goment to arrange how dia own work go be.
10, Worship centres go still dey closed.
11, Civil servants from level 1-12 go still remain at home.
12, Banks and financial institutions go resume work but go maintain di 9am to 3pm order.
No interstate movement. Wey mean say pesin no fit comot or enter into Lagos.
Evri office or shop and motor parks wey open must to get water and soap for hand washing and evri pesin must to dey wear face masks.
Goment go set up whistle blowers to monitor compliance, and if any whistle blower get info, make e send give goment numbers according to govnor Babajide Sanwo-Olu.


Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post











