Coronavirus social distancing: Wetin two metres look like
One of di rule sabi pipo don put down for pipo to keep safe from coronavirus na to maintain social distance. Di required amount of distance you need to maintain from your neighbour na two metres.
But wetin be dis two metres sef?
Imagine one Michael Jordan – dat na roughly how far you need to be from di nearest human being to keep to di recommended two metres for social distancing during coronavirus. Check out some oda ways to imagine am.

