Una tink say shayo fit prevent coronavirus?

Wetin we call dis Video, Una tink say shayo fit prevent coronavirus - inside life.

Drinking alcohol no dey prevent or even kill di coronavirus.

And pesin wey come dey drink oda forms of alcohol like isopropyl or methanol wey dem fit put for hand sanitizer na express you dey go - danger!

Pipo don kpoof or enta hospital sake of alcohol poisoning as dem dey follow dis kain rumour.