Bayelsa Governorship election 2019: Supreme Court cancel David Lyon election, declare Douye Diri of PDP winner

David Lyon and Muhammadu Buhari

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency

Read am in 2 mins

Supreme Court for Abuja don cancel alias nullify Bayelsa State governor-elect David Lyon as winner of di 2019 election for di state.

Di five-man panel of Nigeria highest court now, don declare PDP candidate Douye Diri as winner of di state governorship election.

APC candidate David Lyon bin dey prepare for im inauguration as Govnor of di state wey suppose happun on Friday 14 February, 2020 before dis ruling from di Supreme court comot.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

For November 2019, Nigeria election body Independent National Electoral Commission (Inec) bin declare Lyon of All Progressives Congress (APC) as winner of di 16 November governorship election wit total of 352,552 votes, based on say e score pass 25 percent.

For Inec result, oga Douye Diri of People's Democratic Party score 143,172 votes.

Normally for Nigeria, Supreme Court judgement be final and nobodi fit change am.

Wetin lead to Supreme Court judgement

On 12 November, 2019 Federal High Court for Abuja bin disqualify Degi-Eremienyo wey contest as Lyon deputy say e forge certificate give Inec.

Today, Thursday, di Supreme Court come confam di decision of di High Court say true true David Lyon running mate, Degi-Eremienyo forge certificate give Inec.

Di court rule say Degi-Eremienyo disqualification spoil di joint ticket wey di governorship candidate, Lyon, run for and win di 2019 election.

How pipo for Bayelsa react to di judgement

Jubilation full ground for Yenagoa, Bayelsa State capital even as David Lyon bin dey prepare for e inauguration.

Pipo begin play music plus beat drums as tori of di Supreme Court ruling reach dia ear.

Even sef, some pipo begin bring down flags of APC wey dey for streets of Bayelsa to signal say na PDP dey on board now.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post