Boko Haram attack passengers for Borno kill 30 pipo, burn vehicles

Wia dis foto come from, Borno state government
Officer Isyaku Ya'u of di Borno State Fire Service na one of di first pipo to reach Auno area for Maiduguri wia Boko Haram kill at least 30 pipo on Sunday.
Di officer tell BBC Pidgin say e never sleep well because of wetin im take eye see.
According to Isyaku, dem reach di area immediately Boko Haram finish di kill-kill and wetin im see still dey disturb am for mind.
"I use my korokoro eye see pikin wey no pass four months old wey dem use knife kill and pipo say dem carry di mama go. Also one elderly man wey dem kill because e tell dem say e no get money but dem later see N10 for im pocket."
"E get anoda young girl wey dem kill wey get earpiece for her ears, dem shoot dat one. Di dead bodi wey I use my eye see plenti."
"Dem also burn many houses and cars wey I see, di damage no be small tin." Isyaku tok.

Wia dis foto come from, Borno state government
How di incident happun
Pipo wey carry eye see wetin happun say Boko Haram insurgents attack di passengers wey hook for Borno state, north east Nigeria on Sunday.
Tori be say di pipo land di military checkpoint wey dey lead to Maiduguri afta di time wey Nigerian Army dey close di place, sake of dat, di travellers come dey stranded and get to pass sleep for di neighbouring village Auno, say dem go continue dia journey di next day.
End of Di one wey oda users dey read well well
Boko Haram come raid for night, kill pipo, destroy vehicles. Tori na also say dem kidnap some pipo go.
Among di pipo wey lost dia lives for di Sunday attack na University of Maiduguri student Fatima Abubakar wey her friends and family for social media dey mourn her.
Pipo don enta social media to mourn her death.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Borno state Govnor para
Di Borno State Governor, Prof. Babagana Zulum tear for army sake of wetin happun for Auno.
Di govnor accuse di army say dem dey comot Auno afta 5pm everyday, im say dis na wetin give Boko Haram di leg to carry out di attack on Sunday.
"We don try so di Nigerian Military go establish unit for Auno, dem dey Auno but as soon as 5 o'clock nack, dem dey close gate, lock di pipo out and go back to Maiduguri, na wetin don dey happun be dat." Im tok.
Meanwhile di Head of the military counter-insurgency operation for di North-East (Theatre Commander of Operation Lafiya Dole), Maj. Gen. Olusegun Adeniyi, say di figures pipo dey tok no dey correct.
Di army commander say those wey dey ply di road know say di military bin don set 5pm as di time for closure of di gate.
Meanwhile President Muhammadu Buhari for im reaction to di incident don nack chest say as di armed forces continue to dey receive more equipment and intelligence dem go crush di remnants of Boko Haram.












