Donald Trump impeachment charges no fly for US Senate but wetin Mitt Romney do surprise am

President Donald Trump at the US Capitol Building on 4 February 2020

Wia dis foto come from, AFP

Read am in 1 mins

America Presido Donald Trump fit don dey free sake of di trial for di US Senate don free am of any charges wey fit make dem to impeach am.

But one tin wey many no go forget na di only senator wey dey im party wey no vote am.

Republican Mitt Romney tok am for senate floor say im go tell im children and children children say im do im duty to vote oga Trump guilty.

He tok say: 'to do mago mago to keep power dey abusive and this one go yamayama the oath of office wey im swear.

Romney say he promise God not to dey partial, dat na why he put personal feelings and political bias aside'.

But oga Trump don yab am back for twitter say Romney move na another desperate move for di man wey suppose don beat former presido Barrack Obama.

No Democrats vote to save the presido.

Di Senate, run by di president's fellow Republicans, vote discharge Trump of all di 52-48 charges of abuse of power and 53-47 on obstruction of Congress.

Na only Mitt Romney do wetin make Trump enta twitter on Thursday morning.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Wetin we call dis Video, Watch di impeachment saga from beginning to end