Emeka Ihedioha: 'Everybody know say na me win di 2019 Imo election'
For di first time wey im go open mouth tok to tori pipo afta di surprise Supreme Court Judgment wey sack am as Imo State govnor and bring in Hope Uzodinma, Emeka Ihedioha tok to BBC Igbo for dis exclusive interview.
Oga Ihedioha tok how e react wen im hear di news and im next line of action.

