RCCG: Pastor Adeboye carry placard sake of Nigeria insecurity palava

Wia dis foto come from, @PastorEAAdeboye
Di General Overseer of di Redeemed Christian Church of God Pastor Enoch Adeboye do prayer waka for Lagos with im church members on Sunday 2 February ontop di kill-kill wey dey happun for di kontri.
Pastor Adeboye tell im church members to join for di waka wey im call prayer walk wey Christian Association of Nigeria (CAN) declare to address di kill-kill across di kontri .
Last month Islamic militant gbab and kill di chairman of di Christian Association of Nigeria (CAN) for Michika, Adamawa State north east of di kontri.
According to di Assistant General Overseer of di church, Funso Odesola, about 25,000 Parishes for di church suppose join di protest nationwide.
CAN President, Samson Ayokunle, announce different activity dem to ask for divine intervention to stop di killing of innocent Nigerians.
Pastor Adeboye hold placard wey say "all souls dey precious to God."
Dis dey come afta Senate minority leader Enyinnaya Abaribe ask President Muhammadu Buhari to resign sake of di security mata for di kontri.
Pastor Enoch Adeboye na di General Overseer of Redeemed Christian church, one of di biggest for Nigeria.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di kontri Vice President Yemi Osinbajo na also pastor for di church.










