Police nab man wit 30 phones inside tight short knicker

Wia dis foto come from, dutch police
Police for Amsterdam believe say dem don solve di mystery of how plenty phones vanish for one rock concert afta dem nab one man with 30 mobile phones inside im short knicker.
Authorities believe say di suspect wey be 34-year-old man, dey part of robbery gang wey dey go from place to place dey tiff-tiff.
Di shorts di suspect wear na di type dem dey wear to ride bicycle and e dey tight pesin. Dis fit be how im take hide plenty mobile phones.
Dem stop am after concert fans report to police, wey come block all di exits.

Wia dis foto come from, dutch police
E no dey clear yet if di suspect - wey come from Romania - get oda pipo wey follow operate for di Amsterdam concert, wey happun on 21 January.








