Amotekun: South west govnors and FG don agree on way forward

Wia dis foto come from, Twitter/@Toluogunlesi
Di Federal goment of Nigeria say dem don reach agreement with di govnors of South West states on top dia civillian security plan, Amotekun.
For statement wey di presidency release, considering di fact say all hands must be on deck to address di security concerns across di kontri, dem agree say di Amotekun structure go align with di strategy wey federal goment dey use with community policing.
Di statement also tok say dem agree say all di states go put all di necessary legal instruments in place to give legal backing to di Amotekun initiative and also address all issues concerning di regulation of di security structure
Amotekun, di operation di wey di south west bring togeda to solve herdsmen palava for dia states, get k-leg afta di Minister of Justice Mallam Abubakar Malami tok say di operation dey illegal as e no follow law.
Meanwhile, di Attorney Generals of di six states wey make up di south west also hold dia own meeting to take care of di legal aspect of di agreement.









