Nyesom Wike: Pipo dey use #UsmanDanFodioChallenge to support di chief di govnor yab

@laadestinada

Wia dis foto come from, @laadestinada Twitter

Read am in 2 mins

Some pipo don begin show dia support to di chief wey Nyesom Wike, govnor of Rivers State yab during dia meeting for Port Harcourt, South-South Nigeria.

Dem dey use #UsmanDanFodioChallenge to support di traditional ruler for social media with funny-funny memes afta di video of Governor Wike wey dey yab di chief go viral.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Checkout some of dem here

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4

Skip X post, 5

End of X post, 5

Skip X post, 6

End of X post, 6

But di State goment bin don respond say "na mischievous pipo na im dey chook mouth for serious discussion wey di govnor get with traditional rulers turn am to anoda tin."

Di statement from goment add say, "di govnor get high respect and regard for di traditional institution and traditional rulers for di state."

Tori be say Governor Wike do meeting on Tuesday with traditional rulers wia im ask di chiefs to stand with dia staff of office and warn di ones wey no carry am come say im go remove dem if dem waka without am anytime dem dey do meeting.

Di staff of office na wetin goment dey give first class traditional rulers wey goment recognise.

But pipo for social media dey wonder why Govnor Wike call out one of di traditional rulers during di meeting, dem say e dey important for am to respect and honour dem no matter wetin happun.

Tori be say, na di govnor office get power to classify or rank traditional rulers for Rivers State, wey get Ijaw, Ekpeye, Ikwerre, Ogoni, Ibani and Etche ethic groups.