Trump impeachment: US president go face trial for Senate

Wia dis foto come from, Reuters
Donald Trump don become di third US president for history wey di House of Representatives go impeach to lead to trial for di Senate wey go decide weda im go remain for office.
Di House vote ontop two charges - say di president abuse im power plus say im block Congress.
Both votes happun along party lines with nearly all Democrats wey vote for di charges and all Republicans against.
As di voting dey happun, President Trump bin dey address one campaign rally.

Wia dis foto come from, Reuters
Im tell di crowd wey dey hail am for Battle Creek, Michigan: "While we dey create jobs and dey fight for Michigan, envy, hatred and anger dey worry di radical left wey dey Congress, you see wetin dey happun."
Di White House release statement say di president dey "confident say dem go free am" for di trial for Senate.

Wia dis foto come from, Reuters
Di process on Wednesday begin with members of Mr Trump Republican Party wey call for votes ontop issues wey concern di process in dia effort to frustrate di process.
Wetin follow dat one na vote ontop di rules wey dem go follow for di impeachment, wey kick off 10 hours of debate ontop di merit of di two impeachment charge dem against President Trump.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
About 20:30 local time (01:30 GMT), di House call for votes ontop di two charges: first, abuse of power, dis wan come from accuse say Trump try to pressure Ukraine to announce investigation into im Democratic rival, Joe Biden: di second na obstruction of Congress, ontop accuse say di president no gree co-operate with di impeachment inquiry, im withold document evidence and stop important aides from giving evidence.
Dem pass di vote for di first article impeachment, abuse of power, 230-197 and di second one say im block Congress, 229-198.

Dis impeachment put Donald Trump with two oda presidents for di history of di nation - Andrew Johnson and Bill Clinton - dis wan also set up trial for di Senate for Trump presidency.

Di president bin don chook mouth just before di vote on Wednesday, im write one six-page letter with anger to Ms Pelosi wia im accuse her say she declare "open war on American democracy".
For di letter, wey white house bin publish, di president claim say dem "deprive am of im basic Constitutional Due Process from di beginning of dis impeachment scam". Although infact, di Democratic chair of di House Judiciary Committee bin don invite am publicly to come give evidence, something wey for allow im legal team to also question witnesses, but im no show.















