Miss World 2019: Toni-Ann Singh don win di 69th edition of di pageant

Wia dis foto come from, Getty Images
Miss World Jamaica Toni-Ann Singh don win di 69th edition of di Miss World pageant.
23 year-old Toni-Ann na Women studies and Psychology student, wey wan become medical doctor for future.
Di pageant wey happun on Saturday, 14 December for London, see women from around di world compete for di ogbonge title.
Peter Andre and former Miss World Megan Young na im host di competition.
The three-hour broadcast show how di contestants show off all dia hard work and skills, including di synchronised dance routine dem do.

Wia dis foto come from, Getty Images
Miss World Jamaica Toni-Ann Singh wow di audience with her amazing voice wen she sing Whitney Houston classic song, I Have Nothing.

Wia dis foto come from, Twitter/@MissWorldLtd
Di beauty queen wear one ogbonge silver dress to use take her final walk afta Miss World 2018 Vanessa Ponce De Leon crown am.
France carry second while India carry third spot. Meanwhile Brazil and Nigeria bin also dey di top five positions.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Toni-Ann Miss World moment dey come just one week afta South Africa Zozibini Tunzi take di title of Miss Universe 2019.











