Edward Adamu: President Muhammadu Buhari don choose new oga of AMCON to replace Muiz Banire

Wia dis foto come from, Twitter/@cibnigeria
President Muhammadu Buhari on Tuesday choose Edward Adamu as di new Chairman of di Asset Management Corporation of Nigeria (AMCON).
Adamu wey be current Deputy Govnor of di kontri Central Bank, na Gombe man wey go replace di outgoing AMCON oga, Muiz Banire wey from Lagos state for South West Nigeria.
AMCON na di goment office wey Nigeria create since July 2010 to revive di financial system by making sure say dem resolve di non-performing bank loans inside di kontri economy.
But e be like say di appointment of Adamu dey cause 'gbas gbos' for social media as pipo dey feel say na northern agenda wey di kontri president dey do wit dis appointment dem.
Tori be say na only on Monday 9 December, di President bin appoint Muhammad Nami from Kaduna State, North West Nigeria to head di kontri Federal Inland Revenue Service.
Nami replace Babatunde Fowler, anoda pesin from Lagos South West region wey just finish im first tenure for office.
President Buhari don alreadi send letter give di kontri Senate to confam oga Adamu.
Wetin dey make pipo hala be say within 24 hours, di President don appoint anoda pesin from Gombe state for North East Nigeria put inside anoda big post for Nigeria.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5

End of X post, 6
Who be Edward Lametek Adamu?
Edward Lametek Adamu na Nigerian quantity surveyor, business consultant and leadership strategist.
Im be di Deputy Governor of di Central Bank of Nigeria, di kontri central bank.
President Buhari nominate am for dat role on 1 February 2018, to replace Suleiman Barau, wey retire for December 2017 and Senate confam am for March 22 2018.
Before im appointment to di current position, im serve as di Director of Human resources for di Nigerian Central Bank since 2016.
Dem born Edward Lametek Adamu for June 22, 1959 for Kaltungo, Gombe State, Nigeria
Im go school for Ahmadu Bello University, Nigerian Institute of Quantity Surveyors, Institute of Credit Administration of Nigeria, Wharton Business School, INSEAD, Booth School of Business, IMD Switzerland.
Edward Lametek Adamu na Nigerian quantity surveyor, business consultant and leadership strategist.
Mr Adamu start im career for Unified Public Service (UPS) in 1983 wit di Bauchi State Civil Service.
For im career of thirty five (35) years, twenty five (25) out of am im spend for di Central Bank of Nigeria (CBN).
During im years for di Central Bank, im dey seconded to di Gombe State Civil Service from 2008 to 2010 as di Senior Special Assistant and Head, Procurement Management and Due Process Office.
E return to di CBN in 2010 and dem appoint am as Director of Strategy Management Department for 2012, afta one ogbonge selection process dem later deploy am to di Human Resources Department of di Bank ifor 2016 as Director
Im like to dey write, mentor and do Community Development.
Adamu dey happily married with four children, two girls and two boys.