Nigeria na third for kontris wey suffer terrorism for di world

People carry deadi bodi

Wia dis foto come from, AUDU MARTE

One report on terrorism say Nigeria dey among di top three kontries for di world wey terrorist dey worry.

Di report wey Development and Peace initiative (IEP) wey dey Sydney release say after Afghanistan and Iraq na Nigeria be next in terms of pipo wey dey die from terrorism.

But the report also say di number of deaths from terrorism don reduce dis year compared to 2018.

Nigeria no change for dia position as na di same place dem bin dey for 2018. Ten oda African kontris dey inside di list of di top 20 kontris wey terrorism dey kill pipo.

Tori be say dem say terrorism cases dey increase for di world.

According to di report Nigeria bin face 562 terrorist attacks dis year wey kill 2040 pipo, dis na wetin carry di kontri go third for di list.

Nigeria goment dey fight Islamist group Boko Haram wey begin worry di kontri since 2009.

Di group don carry out several deadly attacks for di north eastern part of di kontri wey don kill thousands of pipo and pursue at least two million pipo comot from dia community.

Dia plan na to establish caliphate for West Africa.

Afghanistan wey be first for di world face 1443 attacks wey leave 7379 dead while second place Iraq face 1131 attacks wey kill 1054 pipo.

Dis report mean say terrorist attack for Nigeria plenti pass Syria wey be fourth for di list wia 662 pipo die from 131 attacks.

For di whole of Europe wey face less attacks dis year di number drop from 200 to 62 wey die from attacks.

Ten African kontries dey inside di top 20 some of dem na Somalia, Democratic Republic of Congo, Egypt and Libya.

See di full list here:

Terroirism index

Wia dis foto come from, 2019 Global Terrorism Index