Mamman Daura pikin say her papa no be ring leader of any cabal for Aso Villa

Buhari and Mamman Daura

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, President Buhari and Mamman Daura

Fatima Mamman Daura, wey be daughter of President Buhari nephew, Mamman Daura don deny di rumour wey dey spread say her papa na im be di ring leader of di cabal wey pipo dey claim say dey for Aso Villa.

During one interview with BBC, Fatima tok say President Buhari and her papa don be close friends since and two of dem get plenti di same friends "wey come make dia friendship dey stronger."

"Everybodi get im own friend wey dem trust with dia life. Dem be friend and dat na why pipo dey tink say Mamman Daura dey control everytin for di Villa," she tok.

Oga Mamman Daura na President Buhari nephew and most pipo dey believe say im get strong influence on President Buhari and APC goment.

Fatima Daura also deny di believe say na her papa dey behind all di decisions wey President Buhari dey take. she say her papa dey "mind im own business and no dey tok too much".

"I know di president dey ask my papa for advice but e no dey wait to see weda dem follow di advise or not."

"We dey always dey tell am wetin pipo dey tok but e go tell us say pipo dey wash im sins with di rumour wey dem dey spread about am and so make we no worry. "

"We no dey comfortable with wetin pipo dey tok, we know say na dia closeness dey cause all dis plenti rumours.'

Mamman Daura

Wia dis foto come from, Mamman Daura

Wetin we call dis foto, Mamman Daura

Analysis from BBC tori pesin, Halima Umar:

Grey line wey dey

Plenti tok-tok bin don full ground afta President Buhari open di door of di Villa for Mamman Daura and im family to come live for one apartment wey dem call Glass House.

But two years ago reports say President Buhari ask am to comot from di apartment so dat Yusuf, Buhari son, go fit stay dia as im dey recover back from one bike accident.

Some Nigerians bin don dey chook mouth on top why Mammman Daura dey stay for di Villa. Some dey see am say na because e get control ova di president, although e no be cabinet member and e no even get any ministerial post.

While odas dey see am as noting oda dan friendship or say na pay back for all di beta tins wey im bin do give President Buhari before im win election.

Although di First Lady neva mention Daura name but she dey always complain about di cabal wey she dey accuse say dey cage her husband and im goment.

President Buhari neva still tok anytin since wen dis new drama dey happun between di two families.