Ghana go start ban importation of 'fake phones' - Communications Ministry

Wia dis foto come from, SOPA Images/Getty
Ghana Communications Ministry say small time de country go ban de use of fake phones.
Government say all de cheap mobile devices wey importers dey carry come de country inside go chop ban so say dem fit reduce cyber-crimes den stuff.
According to Communications Minister, Ursula Owusu-Ekuful, de cheap phones wey people dey smuggle enter de country be poor quality wey dem dey pose health issues give de users.
" We go set up central equipment identity registry den take register all devices for de country inside den take reduce den kind stolen phone, substandard and counterfeit mobile devices" Ursula Owusu-Ekuful, explain.
When den start dey operate, de centre go register all devices for de country inside.
Dem go connect de Ghana Central Equipment Identity Register (CEIR) to de global system for mobile communications association data base so say dem fit know de unique identifier IMEI of devices wey dem approve or ban.
After dem go block all unregistered mobile devices wey dem import into de country den also make sure say de low-quality phones no fit access Ghanaian telecommunication network.








