Port Harcourt hotel killing: Over 70 Women groups, odas do I-no-go-gree

Wetin we call dis Video, Women for Port Harcourt protest hotel serial killings

Over 70 women groups and non-governmental organisations participate for di peace walk to protest di serial killings of young women for Port Harcourt, Rivers state south south Nigeria.

Di I-no-go-gree pipo dey demand apology from police say dem describe some of di victims of di serial killings as prostitutes.

Di protesters wey march go Rivers State Government, Police, Department of State Security and Rivers State House of Assembly dey insist say di women get rights and need to dey protected too.

Di protesters dey demand make security agencies sit up to dia responsibilities and catch di killers.

Di women dey protest

Secretary to di state Government of Rivers state, Tammy Danagogo wey receive di women say di state dey work with di security agencies to chook eye for di mata.

Protesters for House of Assembly
Wetin we call dis foto, Protesters for Rivers state House of Assembly

Dis protest dey come one day afta police confam say dem don arrest two pesin ontop di mata.

Commissioner of Police for di state Mustapha Dandaura tell tori pipo say, na eight victims na im don die by strangulation for eight different hotels wey dem don confam.

Port Harcourt Significant Girls

Wia dis foto come from, Port Harcourt Significant Girls

Wetin we call dis foto, Port Harcourt significant girls protest on Monday September 16 2019 ontop di killings for Port Harcourt

Dandaura say dem arrest one of di suspects on Monday wen one girl tell dem say pesin offer to pay her N30,000 to spend di night wit her so dem come trace am arrest am and di second pesin, dem trace am to Kaduna state for North central Nigeria and di police for dia don arrest and and go bring an come Port Harcourt, wia dem go parade dem.