DSS go obey court order to allow Shia Leader Ibrahim El-Zakzaky travel out

Nigeria secret police Department of State Services (DSS) say dem go obey di court order to allow El-Zakzaky and im wife, to travel for urgent medical treatment abroad.
For inside statement wey tok tok pesin Peter Afunanya sign, DSS go grant di kontri Shia Muslim leader leave to travel to India for di treatment.
El-Zakzaky bin get bail on Monday morning for di attempted murder case wey Kaduna state goment cari go court.
Sheikh Ibrahim El-Zakzaky, wey already dey prison since 2015 and im wife Malama Zeenat Ibrahim bin ask court to give am bail so dat im fit go take urgent medical treatment.
Bayero Dari wey be El-Zakzaky lawyer tell BBC afta di court ruling say say di Leader of di banned Islamic Movement of Nigeria group go fit now travel to India for treatment.
Di court also order say make di goment lawyers escort Sheik El-Zakzaky travel, to ensure he return for di trial.

Dis ruling no be only proof say to leave all doors open to obtain favourable outcomes dey work, but dis court ruling na victory for our dogged determination, patience and endurance ontop di way dem suffer us. Na victory for truth and justice against tyranny and impunity, according to Islamic Movement of Nigeria wey di goment ban and call terrorists some days ago.

El-Zakzaky followers don dey protest for Abuja and oda places for di kontri, to demand for di release of dia leader, wey don dey detention since 2015 even though one oda court don order say make dem release am.
End of Di one wey oda users dey read well well













