Ministerial List: Buhari don set to assign ministers portfolio

Wia dis foto come from, Twitter/@BashirAhmaad
Nigeria Presido Muhammadu Buhari don thank Senate say dem sharparly finish interview of pipo wey im nominate to be Ministers.
Di kontri Senate use five working days from Wednesday July 24 to Tuesday July 30, 2019 finish di screening of 43 ministerial nominees wey di presido bin send dem on Tuesday July 23.
Presido Buhari tok say im hope say im go fit name im cabinet soon, dat is to assign ministry and office name alias portfolio to each nominee.
"I praise di way wey di Senate commit demsefs to confam di ministerial nominees, as dem also ensure speed ontop di mata"
"Di pipo of Nigeria want results, and wit dis list of ministers, we dey confident say we go deliver those results. I go assign specific ministry and office name alias portfolio to di nominee wen we swear in di cabinet." Di presido tok for statement im release on Tuesday night.
Many Nigerians dey hope say di presido fit name im cabinet on Tuesday wey be Federal Executive Council meeting.
Of di 43 Ministers nominee, 7 na women, 12 go be senior members of cabinet onto say dem dey return for second term as ministers while no single pesin under 35 years dey di list.
Hadi Sirika, Chris Ngige, Rotimi Amaechi, Babatunde Fashola, Ogbonnaya Onu, Lai Mohammed, Adamu Adamu, Geofrey Onyema, Zainab Ahmed and Osagie Ehimere na some of di 12 old ministers wey go collect reappointment.
End of Di one wey oda users dey read well well
See di full list di Ministers-to-be
1. Chris Ngige
2. Hadi Sirika
3. Rotimi Amaechi
4. Festus Keyamo
5. Uche Ogah
6. Emeka Nwajuiba
7. Sadiya Farouk
8. Musa Bello
9. Babatunde Fashola
10. Godswill Akpabio
11. Sharon Ikeazor
12. Ogbonnaya Onu
13. Akpa Udo
14. Adebayo (Ekiti)
15. Timipre Sylva
16. Osagie Ehimere
17. Lai Mohammed
18. Baba Shehuri (Borno)
19. Isa Pantami
20. Gbemi Saraki
21. Ramatu Tijani
22. Clement Abam
23. George Akume
24. Sunday Dare
25. Geofrey Onyeama
26. Tayo Alasaodura
27. Olorunminbe Mamora
28. Mohammed Abdullahi
29. Adamu Adamu
30. Maryam Katagun
31. Zainab Ahmed
32. Sabo Nano
33. Zubair Dada
34. Paullen Tallen
35. Abubakar Aliyu
36. Sale Mamman
37. Abubakar Malami
38. Muhammed Mamood
39. Mohammed Adamu
40. Rauf Aregbesola
41. Mustapha Buba Jedi Agba
42. Olamilekan Adegbite
43. Mohammed Dangyadi














