Ministerial list: Dalung, Kachikwu, Ogbe, Dambazau fail to get nomination

At least 20 former Ministers wey serve wit President Muhammadu Buhari for im first tenure no make im new list of 43 nominees wey land on Wednesday.
Inside di new list of ministerial nominees, 12 of dem go return as cabinet members while 31 of dem go be first timers.
Out of 43 names wey Senate president Ahmed Lawan announce to start screening on Wednesday, big names like Solomon Dalung and Audu Ogbe no go return as Ministers.
Aside from di former minister of Youth and Sports, Solomon Dalung and Minister of Agriculture, Audu Ogbe wey miss out, former minister of Health, Isaac Adewole, and Minister of Defence Mansur Dan Ali no go return too.
Oda ministers wey dia name no dey di new list na former minister for communication, Adebayo Shittu, Minister of State for Agriculture and Rural Development, Heineken Lokpobiri, Minister of State for Petroleum, Emmanuel Ibe Kachikwu, and Minister of Niger Delta - Usani Usani.
Meet di former Ministers wey no make Buhari new list
Khadija Ibrahim - State (foreign affairs)
Mamman Ali - Defence
Anthony Onwuka - State (education)
End of Di one wey oda users dey read well well
Okechukwu Enelamah - Industry, Trade and Investment
Aisha Abubakar - State (Industry, Trade and Investment)
Mohammed Bello - FCT
Abubakar Bwari - State (Solid Minerals)
Abdulrahman Dambazau - Interior
Udoma Udoma - Budget and National Planning
Ibe Kachikwu - State (Petroleum)
Mustapha Baba Shehuri - State (Power, Works and Housing)
Audu Ogbeh - Agriculture and Rural Development
Heineken Lokpobiri - State Agriculture
Isaac Adewole - Health
Aisha Alhassan - Women Affairs
Usani Uguru Usani - Niger Delta
Claudius Daramola - State Niger Delta
Amina Mohammed - Environment
Ibrahim Jubril - State Environment
Solomon Dalong - Youth and Sports
Kemi Adeosun - Finance - E resign for September 2018 after certificate palava
Kayode Fayemi - Solid Minerals - E Win election to be govnor of Ekiti state for July 2018
James Ocholi - State (Labour and Employment) - E die for accident on 6 March, 2016.
- ODA TORI DEM YOU FIT ALSO LIKE: Fashola, Lai Mohammed, Saraki dey ministerial list
- How Amaechi, Akpabio, odas ministerial screening take waka
- Six Nigerian ministers wey 'vex' pipo for Buhari first term
- Plane jump off runway for Lagos Airport
- Shiite protesters enta street again afta bloody clash
- Ghana, Nigeria 'retailers war' start again
- Cameroon authority blame MRC for prison riot











