Ebola virus: Nigeria reply to WHO declaration as international emergency

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria Centre for Disease Control don tok say dia National Ebola Technical Working Group go continue to dey work to prevent and dey prepare for any outbreak of Ebola.
Di authorities tok dis one to reply di decision wey World Health Organization (WHO) take to declare di Ebola outbreak for DR Congo as Public Health Emergency of International Concern.
Dis declaration mean say di killer virus fit enta any kontri at any time from now and all kontris for di world must beware.
WHO declare di Ebola virus wey don already kill pipo for Democratic Republic of Congo and Uganda as public health emergency of international concern afta Wednesday meeting. Dis meeting na afta dem discover one case for di DR Congo eastern city of Goma, wey be home to one million pipo.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Health Minister for Democratic Republic of Congo Dr Oly Illunga don welcome di decision and say e no make too much difference because health powers don dey treat di outbreak as emergency for nearly a year.
Nigeria wey get di highest population for Africa say dem dey ready.
"Our national Ebola Technical Working Group go continue to dey work to strengthen prevention and preparedness" Nigeria Centre for Disease Control post for Twitter.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

Wia dis foto come from, WHO
Latest Ebola death
End of Di one wey oda users dey read well well
Di pastor wey be di first pesin wey dem go confam say e get Ebola for di eastern Democratic Republic of Congo inside di city of Goma, don die.
One official confam di tori to BBC tori pesin Gaius Kowene.
Di man bin test positive after im land for di city by bus from Butembo, wey dey 300km (186 miles) to di north of Goma, on Sunday.
Ebola na infectious disease wey dey cause internal bleeding wey fit kill pesin.











