Building collapse for Jos kill more dan 10 pipo for di Central Nigeria city

Wia dis foto come from, Other
Di Red Cross for Nigeria don tell BBC say, di total number of pipo wey don die for di collapse building for Jos north central don increase to eleven.
Di Red Cross Disaster Management Coordinator for di state, Husaini Umar Zakari say as di rescue operation resume dis morning, dem pull anoda four deadi bodi comot.
Police Command for Jos north central bin say di two storey building collapse on Monday evening.
Although e neva dey clear wetin cause di collapse, police say dem mobilise rescue team to di scene fast fast to epp pipo wey dey affected.
Police tok tok pesin, Yyopev Mathias Terna say na around 4pm local time na im dey receive call say building don collapse and with di epp of rescue workers, dem sharperly rescue seven pipo without any injury.
And dat later di rescue team bring out anoda set with different kain wounds and dat dem don cari dem go Plateau Specialist hospital and Bingham university teaching hospital to receive treatment.
Rescue operation still dey on
Di three storey building collapse for Monday evening and rescue operation still dey go on.
Plenti rescue worker bin dey ground since Monday evening till midnight to rescue those wey trap for ground.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem bin dey use excavator, oda simple tools even some dey use dia ordinary hand.
Hundreds of pipo around di area sef join body for di rescue.
Some rescue workers tell BBC say di number of pipo wey die fit climb as pipo still dey underground.
Tori be say di building na pipo homes and shop before and dat di owner of di property, wey dey along butcher line for Jos North Local Goment, Rafiu Kabir die wit im two pikin dem.













