COZA: Pipo dey warm up to protest for Abuja and Lagos

Wia dis foto come from, @biodunfatoyinbo/@busoladakolo
Some group of pipo dey ginger to do I-no-go-gree for di Commonwealth of Zion Assembly (COZA) church for Abuja and Lagos.
Di #NameAndShame Movement for Lagos and di #ChurchToo Movement for Abuja plan di protest afta Busola Dakolo accuse di Senior Pastor of di church Biodun Fatoyinbo say e rape her.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di two groups dey plan to march go di church headquarters for Abuja and di branch wey dey for Lagos.
Ever since di video comot internet don catch fire wit different hastags like #PastorStepDown, #IstandWithTheTruth, #IstandwithBukolaDakolo. Some of di hastags dey support di pastor, odas dey support Busola.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3
On June 28, former member of di church Busola Dakolo accuse di pastor of rape for video interview wey she do for YouTube.
But pastor Fatoyinbo don deny di accuse and in dey threaten to cari Dakolo go court.
Meanwhile Abuja police PRO Anjuguri Mamza tell BBC say dem neva get any report on top di mata.